Why 'Tsotsi' actor Presley Chweneyagae death dey shake South AfricaSouth Africa award-winning actor Presley Chweneyagae don die for age 40, according to statement wey MLA release.
Chweneyagae na ogbonge actor wey dey known for im movie role for 'Totsi', wey later win Oscar award.
Im rise to stardom popular for South Africa sake of im acting skills for movie series wey include 'The River', Zama Zama and odas.
Na Tuesday 27 May tori bin come say di ogbonge actor don die and im death don shake up di entertainment industry for South Africa.
"Na wit profound sadness we confam di untimely passing of one of South Africa most gifted and beloved actors, Pres Chweneyagae, for di age of 40," Nina Morris Lee, CEO of MLA tok for dia statement.
MLA wey be popular talent management company describe Chweneyagae as a 'gifted writer and director.'
"Presley na longtime and cherished member of di MLA family, more dan a client, im be friend, a mentor to many, a beacon of creativity and perseverance."
MLA tok for dia statement say Chweneyagae passion to empower di next generation of artists go remain an integral part of im legacy.
E neva clear wetin cause di death of Chweneyagae but many pipo for South Africa don dey send dia tributes to celebrate di ogbonge actor.
Meanwhile for 2021, Chweneyagae tok for one show say im go like go behind di scenes, away from acting.
"Once I turn forty years old, I go like to look at oda means of making money. I no go retire but I go dey behind di scenes," e tok for di interview wit Cassper on di Braai show.
Ogbonge actors, govment officials and organisations dey late Chweneyagae. Dis na sake of im veri important role for di South Africa movie industry.
Netflix South Africa say di late actor na one of dia own, and dem send dia 'heartfelt condolences to di family'.
Chweneyagae do several movie series wit Netflix for South Africa and e totori plenti South Africans.
Also, South African govment don send condolences to di family of di late actor and di movie industry for di kontri sake of di loss.
"Rest in Peace, Presley Chweneyagae. Di nation mourn di loss of a gifted storyteller wey im talent light up our screens and hearts. Your legacy go live on through di powerful stories you dey tell," South African govment tok for dia
tributes.
Di South African Film and Television Awards also describe di late Presley as a true legend of South African cinema and 'a powerhouse performer wey im talent leave an indelible mark on ur screens and for hearts.'